Lockdown, no movement, no food, no money and no light, na wa o! Guy, abeg una get light?
Staying at home without electricity can be very frustrating especially if you are single and leave alone. It is not any easy for families either. Every household need electric power supply for a number of stuff in the home to make life a little bit easy.
But since when dem talk say dem go give us 2 months power supply free, we light don disappear. Abeg, light dey una side?
I dey reason same maybe e for beta make dem just give us the 2 months electric bill as cash instead of light wey we no go even see. When dem dey charge us crazy estimated bills, we no see light use, shey na when dem wan give am for free, d light go come stay?
Ikeja Electric Distribution Company, IKEDC, abeg convert my own to cash. Na dat one go really help my situation right now as Buhari and Sanwo-Olu no gree credit my account with Covid-19 money.
Guy abeg, una get light? holla me wen dem bring una light o!
1 Comment